As e dey Hot

Somebody pay $2.6m to watch Ronaldo vs Messi for Saudi Arabia

Published

on

Na every day by day Cristiano Ronaldo and Lionel Messi dey prove say na them be GOAT as we don dey hear now say one Saudi Arabia businessman don pay up to $2.6 million pounds just to watch that friendly match between Ronaldo and Messi wey go shele for Saudi Arabia.

The two GOAT of modern-day football go jam each other today for one friendly wey go involve the All-star team for Saudi Arabia league vs PSG. Immediately them announce the match begin sell ticket naim the ticket sold out.

But one fan really no want to miss the match sotay him don spend $2.6 million on top wetin them dey call the most expensive ticket for football history. According to the tory, the organizers wey be the Saudi government’s entertainment ministry release one special ticket wey them call ‘Beyond Imagination’ ticket.

The two GOAT just dey cash out steadily

Anybody wey hold that ticket go watch the match as VVIP, before the match him go enter the two teams dressing room go do paddy paddy with them. After the match him go meet with Ronaldo and Messi one on one, gist with them like family, play with them, take pictures with them and just flex with them.

Na through auction naim them sell the ticket and the money start from $260,000 and people begin bid until the man bid $2.6m. When we ask Aboki to convert am for us, we see say na 2.2 billion Naira we dey talk about so.

Cristiano Ronaldo move to Al Nassr to become the highest paid player in football history. This match fit be the last time wey Messi and Ronaldo jam for pitch and everybody go like witness glory for the last time.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version