As e dey Hot

Romelu Lukaku agents Roc Nation don drop am because him na bad market

Published

on

Lukaku issues don turn spiritual

Trouble don carry chair come balance for Romelu Lukaku house as e don clear sey Roc Nation wey belong to Jay Z don drop Lukaku from the list of players wey dem dey manage.

Roc Nation wey dey  also look after players like Marcos Rashford, Kevin de Bruyne, Wilfred Zaha, Samuel Chukwueze, Tyrone Mings, Eric Bailly and many others don comot all the photo wey resemble Lukaku comot for their website. People wey know as e dey go for football don confirm sey Lukaku and Roc Nation nor wan roll again.

Romelu Lukaku join Jay Z sports management company for 2018 after him leave Mino Raiola company after the super agent death. Nah the same Roc Nation carry am come Manchester United from Everton. Nah still dem carry am come Chelsea from Inter Milan last year. Nah still dem toast Chelsea wey dem for gree loan am go Roma after Chelsea bin sey nah only sell dem wan sell am.

Lukaku matter don turn spiritual

This issue don dey make football people dey put 2 and 2 together because e never tay wey him betray Inter go discuss contract with Juventus for their back. E never tay too wey Juve fans dem carry fight go meet their club oga dem sey dem nor want Lukaku for their club. Then, Chelsea fans don play am tey-tey sey dem nor soro am onto how him insult their club for media under Thomas Tuchel.

All these issues put together don make Romelu Lukaku be like dog meat wey nobody wan buy. And as Roc Nation don decide to divorce am, we nor come know wetin happen gan-gan even as e clear sey Lukaku matter don turn spiritual.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version