As e dey Go

Former Juventus striker chop red card for pissing beside pitch

Published

on

One former Juventus striker, Cristian Bunino don chop straight red card after match officials catch the player dey piss for one corner of the pitch during him club Serie C match wey shele on Sunday.

Bunino dey play for Lecco FC inside Serie C. According to the tory, na for the 76th minute of dem match wey Lecco still dey draw 0-0 with Piacenza naim coach decide to bring in the 26 years old striker as a super sub to hustle for the goal wey fit give them all 3 points.

Na for sideline wey Bunino still dey wait to enter naim piss come begin catch am. When him no fit hold am any longer, the bobo decide to behave like Lagos people, find one corner for the pitch side, bring out him pipe begin piss for there.

But Cristian Bunino no know say person wey dey piss anyhow, eyes wey dey look anyhow dey see am. Na so one of the match officials sight Bunino dey piss for pitch report am to referee and immediately him return from the piss, ref nak am straight red card make him go back house go piss well.

Cristian Bunino piss finish come collect straight red card

Although the club later draw the match 1-1, the red card still pain the coachie. After the match, the coachie use red eyes take come outside begin complain say the ref fuck up, say na yellow card him suppose nak the player.

According to am: “No be like say Bunino open preeq dey piss for public, the guy go one corner go handle him business. Nobody see wetin happen except that ojukokoro official. But even then na yellow card ref suppose give am, that red card too harsh. Abi make person wey piss catch no piss again?”

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version