As e dey Go

Pochettino say na him go break the curse of Chelsea Number 9

Published

on

As Chelsea dey prepare to play Luton Town for Premier League later today, dem coachie, oga Mauricio Pochettino don come outside dey beat him chest say that curse wey dey always follow all Chelsea players wey wear jersey Number 9, na him go finally break am.

Chelsea don dey get jersey Number 9 curse for a very long time, wey go make any better striker wey dem sign nak am Number 9, e go be like say dem use the jersey take tie the player leg sotay him go begin play like amateur.

Right from the days of Mateja Kezman wey score only 4 league goals for one full season before Chelsea vex sell am troway, to Gonzalo Higuain, Tammy Abraham and Radamel Falcao wey come Chelsea on loan, score only 1 goal before dem pursue am back.

The thing worse sotay Chelsea carry Number 9 give defender, Khalid Boulahrouz wey kuku begin score own goal. These days na Romelu Lukaku wey the club buy for £97 million be the Number 9. Before then na former Premier League top scorer, Pierre-Emerick Aubameyang wey join Chelsea begin misfire.

Mauricio Pochettino say na him go break the curse

Na all this negative history don make Pochettino come outside dey shake head say mbanunu, we need to do something about this, even if na to call prayer warriors make dem do deliverance. According to the former Tottenham and PSG coachie:

That Chelsea Number 9 curse na true o and we need to do something about am. I go tell Baba wey dey arrange our kits make him bring all our Number 9 jersey, both home and away and neutral, make him bring dem come outside make we know wetin we go do, even if na prayer and fasting or to pour holy water on top.

Pochettino say after dem do prayer and fasting finish, him go buy one more striker wey him only job na to wear the jersey and deliver goals on top to prove say the curse don break.

Chelsea lose shamelessly to 9-man West Ham for dem last Premier League match and tonight, dem go try use newcomers, Luton Town take record their first win of the season.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version