As e dey Go

Mikel Arteta don beg Arsenal fans not to boo Aubameyang for Emirates tonight

Published

on

As Arsenal dey prepare to host Chelsea for dem London derby wey go shele for Emirates Stadium tonight, Mikel Arteta don come outside dey beg Arsenal fans make dem no boo Pierre-Emerick Aubameyang.

Aubameyang na Arsenal former striker wey give 4 years of him career to the club. In those 4 years, the Gabon striker score 92 goals including goals wey Arsenal take win 2019/2020 FA Cup.

Auba also win Arsenal Player of the Season award for 2019/20 season while also winning the 2019 Premier League Golden boot to become the first Arsenal player to win Premier League Golden Boot since Robin van Persie do am for 2012.

Just like Van Persie, Aubameyang rise to become Arsenal captain and just like Van Persie, the bobo also no leave Arsenal in a friendly manner. This na because the club dey forced to terminate him contract after him and Arteta begin get clash due to indiscipline.

Aubameyang leave Arsenal on mutual agreement for January 2022 go join Barcelona and na the start of this season Chelsea snap am from Barcelona. And tonight, Auba go visit Emirates for the first time since then.

But with Arsenal needing to win to return to the top of Premier League table, Auba dey return as an enemy, leading Arsenal bitter rivals to try destroy any talk of Arsenal winning the Premier League.

Na diswan fit make many Arsenal fans decide to boo am and na wetin Arteta dey try avoid be dat. According to the boss, fans need to remember say Aubameyang serve the club well and score many goals for the club.

”Aubameyang no deserve any disrespect from us. Instead him deserve our appreciation because the guy na incredible player wey score many goals for us. So make we treat am with respect. We need to tell am thank you for wetin him help us achieve. The bobo captain us and him deserve our gratitude.”

Arteta don talk him own but na to see whether the fans go listen. Although dem really no get any reason to disrespect Auba because the guy no do dem anything wrong.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version