As e dey Go

Lion don born fowl- fans blast Ronaldinho pikin after playing igbakugba for Barca

Published

on

Ronaldinho pikin, Joao Mendes don finally play him first match for Barcelona but the boy debut end in disaster as fans wey watch the match don come outside dey blast the boy say if na like so him dey play da mean say lion don finally born okuko be dat o.

Na last month naim the 18 years old boy sign him first professional contract with Barca after scaling trials. And because of the big name and obvious resemblance of him papa, many fans believe say even if him get half of him papa talent, everywhere don jollof for am.

So when dem hear say the boy go finally play him first match for Barcelona U-19, all the whole town come outside go stadium to go watch the pikin of dem legend. As dem nak am Number 7 jersey on top, fans believe say it’s all over, the boy must special like him old man.

But e no tay after match start before fans begin shake head say dis boy no dey play like Ronaldinho pikin, rather e dey play like Sani Kaita pikin. Ordinary ball control sef na problem. Oya drimble defender 1 on 1, baba go turn back, still pass ball give opponent.

Ronaldinho pikin wear Number 7 dey play igbakugba

Na diswan make people rule the boy out say true true, lion don born fowl and if no be say the boy really resemble Ronaldinho, dem for ask for DNA result. According to one of the fans, Ronaldinho pikin no get even chikini talent at all.

Another fan say 16 years old boys full Mushin wey play pass dis Ronaldinho pikin but because ‘Ronaldinho’ no dey dem name, dem no fit get dis kind opportunity wey Joao Mendes dey squander so.

Another fan say if to say na him be Ronaldinho, after dis performance, him for use anger remove the boy from football carry am go begin learn mechanic work for Ladipo or for Ilasamaja because dis football no be the boy calling.

Ronaldinho win 2 La Liga, 2 Spanish Cup, 1 Champions League and 1 Ballon d’Or inside 5 years wey him play for Barca. But the way people don blast him pikin so, if the boy survive Barca academy alone, e go be miracle.

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version