As e dey Go

Lampard go remain as Chelsea coachie till end of season despite 5 losses in 5 matches

Published

on

Despite the balabu and bulaba wey Chelsea dey play under Frank Lampard, we don dey hear now say the club don decide to allow the Chelsea legend to remain as dem coachie until the end of this season.

Lampard na the fourth coachie wey don handle Chelsea this season. The first na oga Thomas Tuchel wey the club sack because e no gree make dem buy Ronaldo. Then Graham Potter take over with performance wey even worst pass Tuchel own.

When the club finally sack Potter after months upon months of pressure from their fans, him assistant, Bruno Saltor take over as interim coachie. After only one match, the club finally employ Lampard to replace Saltor till end of season.

Unfortunately, Lampard don become the worstest of them all as the former Blues defender don lose all the 5 matches wey him don manage as Chelsea coachie. On top of that, him don score only 1 goal while conceding 9.

Chelsea don lose all dem matches under Lampard even jabo from UCL after Real Madrid rush dem

Na diswan don make many fans dey shake head say, mbanunu, we no fit carry dis our billion dollars squad put inside the hand of this man otherwise e go carry us go relegation. And if you check am well, na only 10 points separate Chelsea from relegation zone.

But we don dry hear now say Chelsea oga dem don insist say na Lampard must remain as coachie until the end of dis season. This na according to this report for Sky Sports.

Chelsea still dey hunt for new permanent coachie and we hear say dem go likely announce the new coachie next week. And the way the tin dey go, e be like na another former PSG coachie, oga Mauricio Pochettino naim Chelsea go announce.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version