As e dey Go

Make Mbappe dump PSG, forget about Real Madrid and join Chelsea instead- Chelsea legend

Published

on

As the katakata continue dey happen inside the career of PSG superstar, Kylian Mbappe, former Chelsea winger, Florent Malouda don come outside dey draw ear give the boy say if him know wetin good for am, make him forget about PSG and Real Madrid and join Chelsea instead.

Mbappe na one of the most-talented and highest-paid footballers in the world. According to him contract, the boy dey pocket £1.6 million every blessed week. But now even dat contract go expire for 2024 which mean say him go begin negotiate new contract.

The problem now be say although PSG fit get the money to dey pay am dat kind salary, we no sure say dem get the kind squad wey ready to help Kylian Mbappe win UCL or even World Best for that matter. The France captain don win 5 French League titles but no single trophy outside France.

Na diswan don make Chelsea legend, Malouda wey also be Frenchman don come outside dey toast Mbappe say right now the best place for am to go enjoy football and win trophies na Stamford Bridge. According to Malouda:

”E don tay wey I don dey beg Mbappe to join Chelsea but the boy coconut head strong pass Naija youths own. EPL na the biggest league in the world. And apart from the money, Chelsea na the only club wey fit agree to build their team around Mbappe.”

Malouda win 2012 UCL with Chelsea

The Chelsea legend say right now him former club need one big star and no other club Mbappe go go wey dem go agree to build their team around am now apart from Chelsea. So make the bobo forget PSG and Madrid and choose wisely.

Malouda play for Chelsea from 2007 to 2013. The bobo trajectory almost similar to Mbappe own as him win 4 consecutive Ligue 1 titles with Lyon before joining Chelsea where him win 1 EPL, 3 FA Cup and 1 UCL. The 42 year old legend dey wish say Mbappe follow him footsteps.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version