As e dey Go

If Arsenal no win league, Man United don better pass dem dis season- Rio Ferdinand

Published

on

As Arsenal dey fumble and grumble and threaten to bottle this Premier League title like bottling company, Manchester United legend, Rio Ferdinand don come outside dey proclaim say if Arsenal mistakenly no win dis league, then Manchester United better pass dem dis season.

According to the former United defender, the reason why him talk so na because Manchester United don already win 1 trophy and even if dem finish either third or fourth for league, na the same Champions League qualification dem and Arsenal go get.

Arsenal don dey top the Premier League table since beginning of season till now as the club wey many people refer to as elephant wey climb tree, totally refuse to fall down, contrary to wetin many analysts think.

Up until 2 weeks ago, Arsenal use at least 8 points take dey top Manchester City. Then all of a sudden them squander 2 goals lead away to Liverpool before squandering another 2 goals lead away to West Ham last weekend to play both matches 2-2.

Right now, Arsenal dey top with just 4 points over Manchester City wey still get one match outstanding and one more leg to play Arsenal for home. Na all diswan don make many people dey shake head say, mbanunu, dat elephant wey climb tree don sure say e must crash down.

Be like na Arsenal be their own problem as them don squander 2 goals for back to back matches

And for Rio Ferdinand, once Arsenal crash down and fail to win the Premier League, then Manchester United automatically don better pass dem this season. According to the legend:

”If Arsenal no win this Premier League and Manchester United finish third or even fourth, even if dem no win Europa or FA Cup and na only dis Carabao Cup we win, then forget about it, we better pass Arsenal. If you no like am go to court.”

Manchester United go attempt to qualify enter Europa League semi final when dem visit struggling Sevilla for Spain. Arsenal go play Southampton on Friday night before visiting Almighty Manchester City for a possible title decider clash next Wednesday.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version