As e dey Go

I hate when Ronaldo go drimble me still dey cut eyes for me – Micah Richards

Published

on

Former Manchester City defender, Micah Richards don come outside dey confess say Cristiano Ronaldo na very wucked footballer back when him still dey play for Manchester United because the bobo go use drimble take disgrace defender finish still dey cut eyes for the defender.

Richards wey be City right back then and Ronaldo wey dey like play from United left flank jam each other 4 times for Premier League. During those 4 times, United win 3 with the Portugal hit man scoring 2 goals and 1 assist. And all those 4 times, na Richards dem send to go mark Ronaldo and him fail woefully.

Cristiano later return to Manchester United but by then Richards don retire

And according to Richards, the reason why him fail na because na because Ororo too good and too fast. And the one wey dey pain am pass na say each time wey Ronaldo drimble am, no be the drimble dey pain am pass o, na the way the 5-time Ballon d’Or winner go turn back begin cut eyes dey wink give am.

According to Micah Richards:

Cristiano Ronaldo na very evil player. In fact na before match start sef naim I don already dey fear say dis bobo plan na to disgrace my generation. And true true, whenever him catch me one-on-one, before I know wetin dey happen Ronaldo don count 5 leg over in one second, na so I go dey dance Obesere and just like that the bobo go just drimble me loss.

Micah Richards say na the kind shege wey him dey face whenever him dey play against Ronaldo be that and when Real Madrid finally sign am go Spain for 2009, nobody happy pass am because finally, Cristiano Ronaldo go let the poor breathe.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version