As e dey Go

English Refs go begin add extra time for goal celebrations from next season

Published

on

The football  law making body Ifab and the Professional Game Match Officials Limited (PGMOL) wey dey incharge of referees, don draw ear dey give all teams for the leagues wey dey England sey from next season, dem go begin give additional time for goal celebrations.

This one mean sey dem go dey add on time after 90 minutes cos of time wey teams use take celebrate goals.

This one dey come after many football people for England don complain tire about time wasting for English football. E don tey wey the matter don dey the FA table cos the time wey ball dey in play don small too much.

Dem sey e get some teams wey go dey waste time just to do throw-in. Some fit take 10 minutes to celebrate even goal wey come through penarity. Some go even celebrate offside goal sotey nah VAR go reset their brain.

Refs go begin add extra time for throw in

Nah all these wuru-wuru behavior don make IFAB and PGMOL use red eyes dey tell football people for England sey ko le work sey dem nor go allow cheating for their league and sey make all teams collect warning cos dem go give dem gbas-gbos from  next season. According to dem :

‘we don see am sey time-wasting don become big issue for English football. Una know sey football nah our culture and as we all love football like suya love old newspapers so, we nor go let anything put asunder. We go do everything to make sure sey time-wasting become past tense for English football. So therefore, from next season, we don instruct the referees to give additional time for goal celebrations. We dey do this thing with our church mind and we know sey e go benefit everybody.’

 

Last season, according to Opta wey dey run stats for football, the ball dey in play for average of 54 minutes and 49 seconds out of 90 minutes. The remaining time nah in dem lose to time–wasting. According to dem, for the match between Arsenal and Newcastle United last season, the ball only dey in play for only 51 minutes and sey the remaining 39 minutes nah in dem lose to time-wasting.

Dem go also add time for time-wasting wey result from throw-in, free-kicks and even time wey dem use treat players wey wounjure. Dem sey any players wey need treatment go leave the pitch and sey anybody wey disobey referee go collect wortor-wortor.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version