As e dey Go

Despite Haaland goals, Saka get impact pass am this season- England Legend

Published

on

England legend, Stuart Pearce don come outside dey talk say make everybody forget all those goals wey Erling Haaland just dey score upandan, Bukayo Saka still get performance pass am this season.

Saka na the hottest attacker wey Arsenal get right now with a total of 21 goal contributions for Premier League this season. The boy na one of the powerhouse of the team wey currently dey top table and dey hustle to win the title for the first time since 2004.

But Erling Haaland dey enjoy one of the best debut seasons wey any player don ever get in the history of the premier league. The Manchester City striker don already score 42 goals this season, including 28 for league with 11 matches to go.

Erling Haaland don score 42 goals in all competitions this season

But despite all those goals, oga Pearce still believe say the big striker never play wetin Saka play and according to am, na Saka deserve to win the Premier League Player of the Season. Stuart Pearce talk say:

“I know say Manchester City fans go talk say na Haaland be the best player this season but me I no gree. Na true say Haaland dey perform wonders o, but if we talk of who get impact pass, na Bukayo Saka. If not for Saka, Arsenal no go dey top league now. You no fit buy that kind impact for market.”

Premier League action go return this weekend. Arsenal wey get 7 point lead on top the table go try to extend am when them host Leeds for Emirates. City go try to reduce the gap when them host Liverpool for Etihad.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version