As e dey Go

Bring back Lukaku: Rio Ferdinand don advice Potter to bring back the £97.5m striker from loan

Published

on

As Chelsea dey struggle to score goals wey dem go take win matches, Premier League legend, Rio Ferdinand don come outside dey draw ear give Graham Potter say time don reach to bring back dem big egunu, Romelu Lukaku wey dey outside on loan.

Na for August 2021 naim Chelsea enter market go sign Lukaku from Inter Milan with £97.5 million on top 5 years contract. But the Belgium striker no see him period under former coachie, oga Thomas Tuchel wey make dem bundle am back to Inter on loan after just one season.

And now the big striker don dey rediscover the form wey make Chelsea splash dat kind hooge money on top am, as him score the only goal wey Inter take beat Porto for dem Champions League match wey shele last night.

Chelsea dey fumble this season and at dis rate, dem fit no go Europe next season

Chelsea on the other hand just dey fumble and grumble upandan, winning 1 and losing 5 of dem last 9 matches and scoring only 1 goal in dem last 5 games. Na diswan don make Ferdinand believe say Chelsea need world class striker and dem already get one:

”Since na new coachie dey run the government for Chelsea now, I believe say him suppose give Romelu Lukaku chance to prove himself. Because if you check am, which proven striker dey Chelsea now? Aubameyang no even dey UCL squad, so na who the coachie fit trust to deliver the goals?”

Ferdinand say time don reach for Lukaku to return back home to Chelsea because him get the capacity and competence to deliver dem. Say the bobo always know where post dey and him never even fully fit yet him don bang goals for back to back matches wey him play. What if him come fit?

Romelu Lukaku contract with Chelsea remain 3 years which mean say the former Manchester United striker still get plenty time to make sure say the big money wey Chelsea sign am no be mistake. The problem now na weda the guy wan come back after the last experience under Tuchel.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version