As e dey Hot

Arsenal legend Theo Walcott don finally retire from football after 18 years

Published

on

Theo Walcott nah sabi player

England youngest ever debutant and former Arsenal senior player, Theo Walcott, don confirm for Gary Neville Overlap Show sey him don retire from football. This one dey come after Southampton nor renew him contract after this season wey just end wey dem relegate. Walcott dey 34 years old.

We bin dey hear sey Bournemouth and Reading bin dey price him market but nothing happen. And now, Walcott don kukuma sey him nor do again as e don be like sey big clubs like Real Madrid, Barcelona, Manchester United, Manchester City and Arsenal nor dey come for am again.

Dem born Theo Walcott for Stanmore, London. Him spend him childhood for Berkshire where him do very well before him go join Newbury before Swindon Town sign wen him dey 11 years. But him spend only six months there before leaving for Southampton.

Walcott don confirm sey him nor do again

Theo Walcott spend 13 years for Arsenal where him win three FA Cups and two Community Shields. But wetin most people go remember Walcott pass for nah for 2006 wen England national team coachie that time, Sven Goran Erickson carry am go World Cup at the age of 17. Him tell Gary Neville Overlap Show sey:

‘This decision wey I dey take so dey fear me because I don dey play ball since 17 years or even before then. But I believe sey this nah best time to hang boot and focus on other things wey I fit do with my life. E get many things wey I nor do for small wey I go like do now. I wan thank everybody wey don help me since I start to play ball. God go bless una ‘

Theo Walcott wey score 108 goals in 397 appearances for Arsenal sey him get many clubs wey ready to sign am but sey him feel sey this nah the right time to seke leave football to focus on other things.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version