As e dey Go

Arsenal beat Chelsea, Tottenham to clear the London Football Awards

Published

on

We don dey hear now say Arsenal players and them coachie, oga Mikel Arteta don beat their counterparts from Chelsea, Tottenham and other London clubs clear all the awards for the London Football Awards wey shele last night.

This particular award na for the clubs wey dey play for Premier League wey base inside London. Them include Arsenal, Tottenham, Chelsea, Fulham, Brentford, Crystal Palace and West Ham.

Na Arsenal people dominate the awards this year because them coachie win the Manager of the Year Award. Goalkeeper, Aaron Ramsdale win the Goalkeeper of the Year while Bukayo Saka win the Young Player of the Year for the second time (2021).

Mikel Arteta also win the best coachie of the year award

But na Martin Odegaard win the oga kpatakpata award of them all as the organizers nak the Arsenal skippo the Best Premier League Player of the Year.

Odegaard wey don score 10 goals on top 6 assists for Premier League this season, beat the likes of Harry Kane of Tottenham, Aleksandar Mitrovic of Fulham, Ivan Toney of Brentford and him teammate, Bukayo Saka to grab the award.

Arsenal wey currently dey top Premier League table with 5 points dey hustle to win their first title in nearly 20 years. And players like Ramsdale, Saka and Odegaard dey play major roles for that hustle.

After beating Fulham for London derby on Sunday, Arsenal become the first club to win 5 consecutive London derby away matches without conceding a single goal. So if anybody call The Gunners the king of London, no be lie.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version