As e dey Hot

Graham Potter go remain as Chelsea coachie until next season

Published

on

As Chelsea continue to dey play igbakugba wey don make dem fans begin give up on football, we don dey hear now say Chelsea oga dem, Todd Boehly and the rest, never ready to sack the coachie, oga Graham Potter anytime soon.

Season never go far when Chelsea owner, oga Todd Boehly sack Thomas Tuchel, replace am with Graham Potter wey be then Brighton coachie. The team first dey play well sotay Potter record 6 wins and 3 draws for him first 9 matches as Chelsea coachie.

But then injuries begin hit the squad sotay at a point dem get full squad of 11 players wey dey out with injury. Na then everything begin worwor wey dem begin lose match and chop draw soup all over the place.

But when January transfer window reach, Chelsea enter market spend more than £600m on top high quality players wey make fans begin believe say things go begin turn around. Yet, the results continue to poor sotay now Potter don record only 2 wins and 9 losses inside him last 15 matches.

Na diswan don make many fans believe say na the coachie be the problem and dem don dey wonder when Todd Boehly go finally decide say him cup don full and hit am with sledge hammer. But we don dey hear now say that no go happen this season.

Many fans dey wonder when Todd Boehly go sack Graham Potter

According to the tory, Chelsea oga dem stand gidigba behind Graham Potter and dem no even dey reason the sacking matter. This na because dem believe very strongly say the man get wetin e takes to turn the situation around and make the club into powerhouse both for Premier League and Europe.

The oga dem also believe say the coachie na very honest and analytical man wey no dey put him own interest first which was why him decide to rest player like Reece James because report show say him fit sustain another injury.

So rather than risk James injury all because him need to win match, him still choose to rest am. Na all those kind behaviour dey make the oga dem believe say Potter really carry the welfare of the team and players above him own. Dem no wan sack da kind pesin.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version