As e dey Go

Antony dey confused, Mohamed Kudus better pass am – Marco Van Basten

Published

on

As Antony still dey struggle to make any kind of impression for Manchester United, football legend, Marco Van Basten don come outside dey shalaye say Antony na very confused footballer and Ajax boy, Mohammed Kudus better pass am.

Na when Manchester United snatch Erik Ten Hag from Ajax naim the coachie say dem must also bring Antony along. Na diswan make United count £86m go pay Ajax to bring Antony to Old Trafford.

But since the bobo join the club him shoe never really shine as him don score 5 goals and 1 assist inside 22 appearances in all competitions. On top of dat, the 22 years old Brazilian like to dey do skills wey no get head or tail, wey make United legends blast am.

Na diswan don make many fans dey think say e be like say the bobo never serious for him career. And Marco Van Basten don come outside dey clarify say no be unseriousness dey worry Antony, na just confuse him dey always confuse for pitch:

”Antony na Brazilian wey get skills plenty. But na overskill dey always kill monkey that’s why for pitch, once Antony head full like dis, the bobo go just confuse kpatakpata. Him no go know wetin him wan do again so him go begin play igbakugba.”

Marco Van Basten say Kudus beat Antony hands down

Oga Van Basten say Kudus no dey malfunction like dat. The living legend say Antony fit dey faster, but if you talk of football sense, football technique, and all round awareness, Mohammed Kudus go body Antony any day and any time.

Kudus wey be 22 years old Ghanaian don already get 16 goals involvement for Ajax so far dis season. And Van Basten say na because the boy fit play anywhere for attack, left or right or center, anywhere you put Kudus, him go play and him go deliver.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version