As e dey Hot

Naija boy Calvin Bassey don agree to join Ajax from Rangers on top €27m contract

Published

on

We don dey hear now say Ajax don sign Naija Super Eagles defender, Calvin Bassey from Rangers on top total contract package of 27 million euros. The sign-on fee na 22 million while the add-on na 5 million. On top of dat, if Ajax sell am in the future, any amount wey dem sell am, Rangers go receive tithe of 10% from there.

Una remember say na few days ago naim Ajax sell dem big egunu defender, Lisandro Martinez to Manchester United for 46 million pounds. As e be now, na Bassey naim Ajax don sign to take replace Martinez so. Na better market Ajax enter so because na half of the money wey dem make from Martinez naim dem take buy him replacement so.

Calvin Bassey na one of 3 Naija boys wey dey play for Rangers alongside Joe Aribo and Leon Balogun

Calvin Bassey wey dey 22 years old join Rangers from Leicester academy on top free transfer for 2020. Although the bobo no too see him period for the 2020/21 season, na last season Bassey finally arrive after him play 37 league matches for Rangers as well as 15 matches for Europa League.

Calvin Bassey win Scottish Premier League as well as the Scottish Cup with Rangers. Last season the bobo follow carry Rangers enter the final of Europa League where dem lose 5-4 on penarity to Frankfurt. Bassey finally enter the Europa League team of the year for 2021/22.

Bassey wey dem born for Italy but grow up for England dey eligible to play for those two countries but the bobo quickly decide to play for the country of him parents instead. Him papa na Igbo man, Kingsley Ikenna Ughelumba while him mama, Ebere Bassey Etim from Akwa Ibom. Him brother, Matthew Bassey, na popular rapper for UK wey dem dey call Y.CB.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version