As e dey Hot

‘Antony na agbado winger wey just dey fall our hand’ – Rio Ferdinand

Published

on

After Arsenal score late winner take beat Manchester United 3-2 for them EPL match wey shele last night, United legend, Rio Ferdinand don come outside dey blast Antony say as a winger, the guy dey fall hand seriously.

According to the former United Number 5, Antony dey beat defenders for Ajax anyhow but since him land for Old Trafford, e just be like say them pour ice water for him body and all those things wey him dey do for Ajax, him no fit try am here. According to Ferdinand:

”I remember before we sign Antony, I watch him clips and the way him dey drimble defenders sweet me well well. But e be like say those clips deceive me because wetin we order no be wetin we finally get. Because this our Antony no fit beat defenders to save him life.”

Antony shine under Erik Ten Haag for Ajax but the guy don turn to balablu for Old Trafford

The one wey shock Rio Ferdinand pass na during United match with Arsenal when Antony get one through ball wey everybody believe say him go use speed take win the ball go score. Instead na Partey wey no sabi run naim still come from behind chance the ball from Antony.

Na there Ferdinand realise say problem dey:

”The thing shock me o, as Thomas Partey wey no sabi run still run pass Antony. Na then I realise say this guy no go fit beat any serious defender because him no get power for leg to pass anybody. So after all those skills, no power or speed to follow up.”

Manchester United sign Antony from Ajax on top £86 million contract. But since him land for Old Trafford, apart from a few goals once in a while including the opener for the first leg against Arsenal, the bobo never really show why him worth that money.

For them match with Arsenal last night, Antony loss sotay Na him get the worst player rating according to many pundits with rating of not more than 5.5.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version