As e dey Go

Onana hand still dey shake as Baba drop him car keys for Airport

Published

on

Onana dey do bonanza as him don turn Amino Kpakpakpa

Cameras for Manchester don capture Andre Onana where him car keys dey fall from him hands like person wey drink shaky-shaky daddy. This one dey happen as Manchester United players dem land for Manchester Airport after Bayern kpokpo dem 4-3.

Onana nor go like remember the Bayern Munich vs Manchester United match wey shele on Wednesday after him sell match give Leroy Sane. Andre Onana become transparent as him allow Sane weak shot wey be like back pass roll pass under him armpit. Nah from there United start dey collect wortorwortor.

Even if him don come out to beg and own up to him errors with him full chest, people wey see am drop him keys don dey ask weda the akoba adaba wey make am dey do bonanza for  opponents so don follow am return from Munich.

This iconic photo of Onana teammates helping am recover after doing bonanza for Bayern don flood the internet

Nah Onana request sey him wan talk to media people after the Bayern match to explain the kind juju wey make am dey collect goals like basket. Onana wey Man U sign £47.2m from Inter to replace David De Dea don explain tire but the only evidence wey dey outside na the fact say him don already chop 14 goals this season wey just start so.

As him nor fit save even him car keys, football people don dey tell Ten Haag to chuk eyes for Andre Onana matter because e fit red again for United this weekend as dem dey travel to Turf Moor to go play Burnley. Oyinbo people dey sey once beaten twice shy but nor be for where Onana dey becos him nor dey gree shy samsam.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version