As e dey Go

‘Yeye league, worwor pitch, hungry players naim make Naija football no fit better pass Morocco’ – Gernot Rorh

Published

on

Former Super Eagles coachie, oga Gernot Rorh don come outside dey confess the reason wey make Naija football no dey the same level with Morocco own and according to the German strategist, the problems plenty.

Morocco make the continent of Africa round for the Qatar World Cup wey just conclude when them beat Cristiano Ronaldo Portugal for quarter final to become the first African country to qualify enter semi final for the history of World Cup.

Although Morocco collect 2-0 beating for the semi final wey them play against France and later loss the third place match against Croatia, e still no stop many people from to see say no other African country dey Morocco level for football.

Morocco become the first African country to qualify for World Cup semifinal

And oga Gernot Rorh wey carry the Super Eagles go the 2018 World Cup no even want make anybody call Nigeria inside the equation. According to am, the problem wey dey affect the country football plenty reach to full aboki basket.

”Shay make I talk about the stadiums? Lagos get 2 stadium. The main national stadium we no even fit host inter-house sports there talk less of professional football match. The other stadium naim we fit manage host inter-house sports there.”

Oga Gernot Rorh also talk say the money wey them dey pay footballers for Nigeria be like money wey them dey pay casual workers wey dey do laborer work. That is the ones wey dey see them salary o, because many of them the club dey owe them salary upon allowances.

But the biggest problem according to the former Super Eagles boss na say the clubs no get better youth development system so na different academy wey dem business na to use players take hammer na them dey run youth development for Naija.

With all this kind problem naim we dey expect say Naija go fit near Morocco level? We just dey play.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version