As e dey Go

Woman lawyer for Saudi want make dem deport Ronaldo for grabbing blokos for public

Published

on

One woman lawyer wey be SAN inside Saudi Arabia don carry petition go court say make dem deportat Al-Nassr striker, Cristiano Ronaldo from the country because of the crime of indecency and public dishonour wey him commit.

Na after Al-Hilal kpokpo Ronaldo club, Al-Nassr 2-0 for dem Saudi League match naim Al-Hilal fans decide to add salt inside injury begin chant Messi name round the whole stadium.

Everybody know say Messi na Ronaldo arch rival wey many people expect to soon join Saudi League come boss Ronaldo there. Na diswan make the former Manchester United striker provoke and in response, grab him blokos take tell dem f*ck you.

Na that grabbing of blokos don make this woman lawyer, Barrister Nouf bin Ahmad come outside with provocation say dem must deport the GOAT from Saudi Arabia before him teach their children aneema behaviour. According to her:

“I don already write my petition finish, na to go submit am for court naim remain. Because na big crime Ronaldo commit so, we dey call am public dishonour. And the punishment for this crime na arrest straight to Kirikiri first then for a foreigner like Ororo, na straight deportation.”

Many people expect Messi to later join Saudi League come torment Ronaldo

No be only Barrister Nouf dey complain o, as we don hear say even Saudi journalist dem don dey provoke say which kind nonsense indecent behaviour be that? Dem don also dey ask Al-Nassr to terminate the guy contract with immediate alacrity.

Saudi Arabia na the capital of the Muslim world therefore no be country wey anybody go dey do anyhow. In fact when Ronaldo just join the club, some people say him no fit live together with him woman because dem never marry.

As e be now, nobody know whether Ronaldo ready to apologise for this public indecency wey him don commit for Saudi Arabia so abi the country and the league go even get mouth to nak am ogbonge punishment for the matter.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version