As e dey Go

Weghorst no good enough to play for Man United, the guy suppose be defender – Scholes

Published

on

That 7-0 demolition wey Liverpool demolish Manchester United still dey pain many of them fans and legends sotay them dey find scapegoat upanadan. Now, Paul Scholes don come outside with anger dey talk say Wout Weghorst no dey good enough to dey play for the club.

Weghorst wey represent Netherlands for Qatar 2022 World Cup use some flash in the pan display take whyne United coachie, oga Erik Ten Hag. And by the end of January transfer window, the coachie don sign am on loan from Burnley come Old Trafford.

But since the giant striker join the club, him don manage just one goal (for Carabao Cup) and 3 assists in 14 appearances in all competitions.

Liverpool destroy Manchester United 7-0 for Anfield on Sunday

But the guy get plenty energy wey dey make am run everywhere at once sotay him no even get regular positioning because today him dey play striker, tomorrow na AM, sometimes e dey be like say him dey play DM sef.

Na wetin don make Paul Scholes single am out dey complain say:

Them say Weghorst na striker but each time I watch am play, na defender I dey see. I dey see as him dey run around everywhere and people dey hail am say him get energy and him dey help other players. But e get the quality of players wey suppose dey wear our jersey and if you check am well, Weghorst no get am.

Manchester United don already win the Carabao Cup dis season but dat 7-0 kponking wey them collect against bitter rivals Liverpool go be like pesin wey dey chop beans wey sweet come mistakenly chop stone inside.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version