As e dey Go

Twitter werey owner, Elon Musk dey reason to buy Manchester United

Published

on

As Glazer family don put Manchester United for sale inside market so wey some kind different different people don dey chook eyes inside the matter, we don dey hear now say the owner of Twitter and the  second richest man in the world, Elon Musk don dey consider weda make him just close eyes buy the club the way him buy Twitter.

Una remember say na last year naim Glazer family declare say them don tire for all the wahala wey them dey get because of the club especially for them fans so them kuku decide to sell the club make every body rest.

At first na only one of the richest men for UK, Sir Jim Ratcliffe bid for the club but last week naim some Qatari investors carry oil money enter the matter with the promise say them go give United coachie, oga Ten Hag too much money to sign players as him like before then tear down Old Trafford build am back to New Trafford.

But now, we don dey hear say tech billionaire and Twitter owner, Elon Musk don dey consider the matter. The Tesla owner been don tweet before say him go buy Manchester United before tweeting again say na play him just dey play. But anybody wey know Elon Musk know say everything him dey do dey start from play-play.

Manchester United owners wan sell the club and the fans support the move

Even Twitter wey him buy, na from play play and before we know wetin dey happen, him don buy the company. And with him networth wey dey around £157 billion right now, the £4.5 billion wey them dey price Manchester United be like chicken change for am.

Deadline for bidding to buy the club suppose end on Friday and if Baba Olowo go make bid to buy the club, we go know on or before Friday.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version