As e dey Go

Ramsdale papa say Caragher na agbaya for calling him pikin hater

Published

on

Ramsdale senior sey Carragher nah disgrace

Arsenal goalkeeper, Aaron Ramsdale papa don tear shirt tear bra onto say Liverpool legend, Jamie Caragher, say him pikin nah olofofo wey dey pretend like sey him dey happy for others but inside their mind, dem dey pray sey the happiness nor last.

This one dey happen after camera capture Ramsdale wey dey for bench dey clap for Raya for one sweet save wey him make for the match between Arsenal and Tottenham wey end for 2-2 draw yesterday.

Carragher come go social media dey say Ramsdale nor actually dey happy for Raya and say the situation be like Oscar awards for people wey dey act film. Him say for the Oscar awards, you go see people wey nor win any award but nah so dem go dey smile and clap for the people wey win. But for their mind, dem dey vex. Caragher say nah exactly wetin Ramsdale dey do.

Ramsdale senior sey Carragher sense dey do stop and start

Nah this bad bele make Nick Ramsdale wey be Aaron Ramsdale papa sey Carragher nah disgrace and sey him nor get class like him pikin get. Him sey Carragher nah person wey him sense dey do stop and start.

As e be so, e don clear sey Carragher dey sabi find talk wey talk nor dey. Him pundit work don give am the liver to dey talk to anybody as him like. This Ramsdale matter don become wetin many football people don use know Carragher. We just hope sey dem nor go break him head one day.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version