As e dey Hot

‘Police suppose arrest Casemiro for turning football into UFC’ – Agbonlahor

Published

on

After that street fight wey shele during Manchester United match with Crystal Palace on Saturday wey Casemiro wan use chokeslam take comot Palace player neck, Gabriel Agbonlahor don come outside dey ask police to arrest the Old Trafford midfield marshal for that vagabond behaviour wey him behave there.

Na when United dey lead 2-0 wey Palace dey hustle for one goal naim street fight burs for pitch wey all the Manchester United players begin fight the Crystal Palace players. Before we know wetin dey happen, Casemiro don grab Will Hughes for throat begin strangulate the guy sha.

Thankfully them finally separate the fight before the former Real Madrid midfielder kill the guy finish. Referee been no see wetin happen but when him finally check VAR see am, na straight red card him nak Casemiro.

Casemiro dey choke Will Hughes like Brock Lesnar dey choke people for UFC

But Agbonlahor no believe say that red card dey enough for attempted murder. The former Aston Villa striker believe say police suppose arrest Casemiro lock am up inside Kirikiri for that kind behaviour. According to Agbonlahor:

”Somebody need to tell Casemiro say na ball we dey play here, no be UFC. Because I no understand why you go dey strangulate your fellow footballer, shay your name na Brock Lesnar? Small children watch that match and them go see that kind behaviour think say e dey normal. Them no go know say na criminal behaviour be that.”

Agbonlahor also ask police to quickly arrest Casemiro while calling on Manchester United to discipline the guy make him no go dey think say him be Iron Monkey wey fit dey run people street anyhow on top pitch.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version