As e dey Hot

Them suppose lock that ojoro referee inside prison forever – Edinson Cavani

Published

on

World Cup don over since but e be like say some people still dey carry the grudges from Qatar since last year enter this year because we don dey hear now say Edinson Cavani still never forgive or forget that referee wey officiate Uruguay last match for Qatar 2022, oga Daniel Siebert.

And right now, the Uruguay big striker don dey move motion for the kind punishment wey them suppose punish the ref. Him no want make them suspend or fine the referee o. Cavani just want make them arrange small room and parlour for the ref inside prison make him no come outside again.

Uruguay last group stage match for Qatar na that grudge match against Ghana. Uruguay need to win 3-0 to qualify enter quarter final. Them don already dey win 2-0 when Ghana decide say Uruguay must not score that last goal wey them for take qualify. Na so match take tie wrapper o.

Uruguay try them best until the dying minute when Darwin Nunez fall under the anointing of Ghana defender, Alidu Seidu. Na so all the Uruguay players rush the ref believing say na sure penarity be that but the ref say na lie. Them beg am to go check VAR but him no even answer them. When Cavani cap anyhow, baba collect MTN.

Uruguay players think say them don win penarity but referee no even answer them

After the match naim Edinson Cavani use anger take punch the VAR TV and now e be like say FIFA wan punish am for that behaviour wey make am come outside dey insist say them suppose punish the German ref, oga Daniel Siebert as well.

According to the former Manchester United striker: That referee them suppose find bed space for am inside Kirikiri because the man ojoro too much. Who no know say that ball na penarity? One ref just decide to use ojoro take remove a full country out of World Cup and you tell me say them no suppose lock am up for Alagbon?

Edinson Cavani and him Uruguay teammate, Jose Maria Gimenez fit chop sanctions because after the match when Uruguay players pursue the ref enter tunnel, Cavani punch VAR TV put for ground while Gimenez elbow FIFA match commissioner for neck.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version