As e dey Hot

Paul Pogba fit chop 2 years ban after failing drug test for Italy

Published

on

Pogba problems don turn bicycle wey nor dey spoil

Midfield general, Paul Pogba, don test positive for drug wey dem dey call testosterone. Italo media people dey sey the thing happen wen dem test am before their  opening Serie A match against Udinese.

Pogba nor play the match but dem sey nor be the drug test wey him fail make am nor play the match. The World Cup winner wey return to Juventus from Manchester United last season don play only 32 minutes this season for him club.

Football people don sey Pogba problem don turn bicycle wey nor dey spoil. Since him leave Man U, injuries, fitness and other issues wey nor concern football don dey worry him football career. Even Juventus don dey wonder weda nah the real Pogba dem sign abi nah another person wey resemble am.

Pogba don take wetin nor good for him brain

E nor va tey wey him just finish him blackmail family matter wey him brother, Mathias Pogba, bring come him doormot. As that one dey finish, another injury different from the one wey dey worry am before come. After that one, fitness issues come. Fitness issues never end, this drug test wahala don show like early mor-mor akara.

Testosterone nah energy booster drug wey dey boost body size and energy wey fit make player turn cheat for field. The National Anti-doping Tribunal go investigate the matter. If dem find am guilty, dem go nak am two years ban but if dem find out sey him use him two korokoro eyes do am, dem fit ban Pogba for four years.

If this one happen, Pogba don jump from frying pan enter fire be that because dead body nor suppose get accident.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version