As e dey Hot

BREAKING: Manchester United don sack Mason Greenwood

Published

on

As e dey hot, we don dey hear now say Manchester United don sack their winger Mason Greenwood with immediate alacrity. This one dey come after months upon months of analysis and deliberation on whether the United academy product go play for the club following him sexual harassment case.

Na for January of last year naim Greenwood enter hot water after him girlfriend then release tape where the winger dey threaten to beat her and sexually harass her. She later back am up with videos of the beating wey Mason Greenwood take panel beat her scatter all her fine face.

Na since then Manchester United suspend Greenwood before the matter go court. Although court dismiss the case based on technicality as dem no fit continue with the evidence wey dem get, the video and soundtrack don already spoil many people mind where Greenwood dey.

Manchester United female fans protest say dem no want Mason Greenwood again

Many people wey dey linked to the club don chook mouth say make Mason Greenwood no ever play for the club again. In fact, United women supporters come outside come protest say dem no expect the club to fall hand carry Greenwood back to the club sey dem expect the club to do the right thing.

As e be now, the club don finally tell Greenwood say him no get place for the club again and as e be now, make him go find another club far away from United where if him beat woman or try to rape woman, nobody go do am anything because the forces wey dey around United too strong.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version