As e dey Go

Obi Mikel say him nearly shit for body when him see Ferguson after dumping United for Chelsea in 2005

Published

on

Former Chelsea and Naija Super Eagles midfielder, John Obi Mikel don come outside dey confess say after him dump Manchester United sign for Chelsea, him begin hide from United coachie, oga Alex Ferguson. But the day him finally jam am, him nearly shit hot shit for body.

If una remember wetin happen for 2005 when Obi Mikel just turn 18 years old naim Manchester United under Ferguson run go sign am from Lyn Oslo inside Norway without informing Mikel agents. In fact Mikel even wear United jersey take do one press conference after dem sign am.

Na diswan make the agents provoke come outside say all dat signing wey United do na play dem dey play because dem don already get agreement with Chelsea to sign Mikel for £16 million. Mikel sef later come outside say no be clear eyes him take sign the contract because United put gun for him head to sign.

Las las na FIFA finally settle the matter and Mikel finally join Chelsea. But since then whenever Chelsea wan play United and Mikel Obi see Sir Alex Ferguson, guilty conscience go make am begin dodge upandan. Sometimes him go hide for staircase, another time if him see SAF dey come, him go corner the opposite direction.

Mikel say him begin fear Alex Ferguson

But na one day Obi cup finally full. United wan play Chelsea and as him dey climb down from stairs inside stadium, him jam the legendary United coachie face to face without room to escape. Mikel say:

”Walai talai sumobinlai, I nearly shit for body dat day. In fact I loose my footing and nearly fall from the steps. But I no go forget the kind bad eyes wey Fergie look me, na dat kind bad eyes wey our mama dey look us when we small, when we don fock up but dem never wan treat the fock up. Fergie look me dat bad eyes for like 5 seconds then begin chew him chewing gum with anger. I no go ever forget dat day.”

But after dat day Obi stop to dey hide from Fergie because the worst don already happen. After a while him and Ferguson even begin rapport again, dey greet each other and even talk about wetin happen back then for 2005. Mikel apologize and Ferguson forgive am and now dem be like papa and pikin.

The Super Eagles midfielder later play 11 years for Chelsea and winning everything winnable for Chelsea including Premier League, Champions League, FA Cup, League Cup and Europa Cup.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version