As e dey Go

Naija League: Wikki Tourist fans beat up Bayelsa United officials after losing for home

Published

on

No be small sontin shele inside our Naija top flight wey be the Nigeria Professional Football League after fans of Wikki Tourist invade pitch after dem club lose 2-1 for home to Bayelsa United begin attack Bayelsa officials.

According to wetin we hear, na during the match wey shele for Bauchi naim Wikki Tourist score one goal wey referee disallow. Bayelsa United finally beat Wikki Tourist 2-1, and e be like na the anger of losing for their own backyard trigger the fans.

Immediately the match end naim the fans storm the pitch begin attack Bayelsa United people. In the end na Bayelsa Chairman, oga Timitimi Ebiki, and dem cameraman naim the fans catch, begin kpokpo dem before police finally intervene to save dem from the fans.

The Bayelsa United chairman sustain some bruises for him neck and back after the fans plank am from behind. As for the cameraman, dem nak am put for ground, beat am small then tear him shirt.

Last week naim Remo Stars GM attack referee during match

Na only last week naim Remo Stars chop fine of N1.2 million plus 3 points deduction after dem General Manager, Ekene Adams attack referee after dem play 0-0 draw with Gombe United. Na to see the kind punishment wey Wikki Tourist go chop for dis atrocity wey dem commit so.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version