As e dey Go

Naija League rank Number 10 best league for Africa

Published

on

We don dey hear now say our Nigerian Premier Football League (NPFL) don rank number 10 best league for the whole Africa. This na according to the new ranking wey CAF release to take show the different African leagues them level.

For the latest ranking, Egypt Premier League remain the best league for Africa. Botola Pro League of Morocco carry second while the Professional League of Tunisia carry third. South Africa Premier Soccer League follow behind for fourth while fifth na Linafoot of DR Congo.

The Number 6 best league for Africa na the Zambia Premier League, number 7 na Sudan Premier League, number 8 na Tanzania Premier League while number 9 na the Professional Ligue 1 of Algeria. Na our Nigeria Premier Football League (NPFL) naim carry first from back inside the top 10.

Enyimba remain the only Nigerian club to win CAF Champions league

But the thing no always be like this because all that time wey Naija clubs dey always qualify for CAF competitions still go far on top, the league dey rank even as high as Number 5 when Enyimba still be Enyimba. But now to even win play off qualify na wahala talk less of to go far.

The last time wey Nigerian club win CAF competition na 2004 when Enyimba win the CAF Champions League. And with the kind poor administration wey dey happen for the league nowadays, e go tay before any NPFL club go come close again.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version