As e dey Go

Naija League players dey earn between N250k and N500k but na mismanagement dey kill dem

Published

on

As the argument about whether Naija League players dey earn enough money to live comfortably continue to dey rock, one Naija football enthusiast don come outside dey reveal say the average NPFL player dey earn between N250,000 to N500,000 a month.

But according to the enthusiast, oga Edafe Matthew EseOghene aka Elegbete, na mismanagement dey always kill the NPFL players because most of them believe say dem go eventually go abroad go hammer so dem no dey invest their money wisely.

According to Elegbete, If you see bankers, or stocker brokers or even insurance salesman, journalists and other profession in Nigeria dey collect da kind money, dem go dey ball like say dem don hammer, invest and take care of children and family.

“The average NPFL player believe say him go go Europe. Na dat belief dey make dem always squander their money believing say when dem go Europe dem go hammer. About 800 players dey play Naija league every season, the ones wey dey make am to Europe no reach 1%. So why dem dey whyne demsef?”

Many NPFL players dey expect to jakpa so dem no dey invest their money back home

Similar to oga Elegbete, another sports journalist, Quadri don chook mouth for the matter say na true. According to am, him don see NPFL players wey build houses and hotels for Naija with their salary. If the players focus, their salary go help dem live well.

The argument about whether Naija league dey pay well go continue dey show face, especially when Europe na option and even other African countries dey pay better. Another issue na how many clubs no dey owe players salary.

But na for dis same Naija we see Enugu Rangers player use him salary take dey support himself and less privileged for community. So las las, whether the money dey enough or not depend on the player himself.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version