As e dey Go

Na your papa born you – fans hail Wayne Rooney pikin for playing like him papa

Published

on

As the children of former football stars dey struggle to fill in the name wey dem papa leave behind, fans don dey hail Wayne Rooney pikin, Kai Rooney, say the small boy really dey run show like him old man, no difference.

Na for 2020 naim Kai Rooney sign for Manchester United as a 10 years old boy and since then, the boy don dey show say no be only him papa goalscoring talent him get but him also get him papa moves and posture.

Kai wey be Wayne Rooney first pikin dey play as striker for Manchester United U-13. The boy score 56 goals on top 28 assists last season alone. This include the goals wey him score take lead United win the Under 13 National North Trophy.

Kai Rooney even dey control ball and score goals like him old man

The boy good sotay Puma don already sign ogbonge sponsorship deal with am and right now, the boy don swear say in the next 10 years, him self go don dey do exploits for United. Na all diswan make fans come outside begin hail am say true true, na him papa born am.

According to one fan, we no even need DNA test to show us say Diswan na small version of Wayne Rooney. Everything wey him papa get, e dey him body. From ball control to chesting and even finishing, him dey play exactly like him papa.

Another fan say diswan na the true meaning of say lion no dey born goat because dis pikin dey give us full Wayne Rooney vibes. I can’t wait to see dis boy playing for the senior team because based on wetin I dey see so, na another killer striker United dey train so.

Na just last week naim video of Ronaldinho pikin turn up wey the 18-years-old boy dey play igbakugba for Barcelona U-19. Na diswan make many people begin wonder weda lion don finally born fowl because the boy no get any single talent of him papa.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version