As e dey Go

Na football turn me to ogogoro man – former Leeds and Reading coachie

Published

on

My people this football don bring many people joy and success. But for some people, the thing don bring them serious sadness because former Reading coachie, oga Brian McDermott don confess say na football naim turn am to ogogoro addict.

According to McDermott wey also coach Leeds; my problem start when I retire from playing football yet I never make am. So I decide to become football manager maybe na from there I go finally make am but football manager come be like say e hard pass when I dey and na da wan make me begin frustrate.

Oga McDermott lose 2011 premier league promotion playoff final to Swansea

Because of him frustration, whenever him club Reading lose match, oga McDermot go waka from stadium straight to Mama Efe shop go begin drink ogogoro, tombo, kai-kai, monekytail, skushis and other alcohol to take cool him temper.

From then the thing graduate from only when Reading lose to whenever Reading draw. And when that one self no do am, the coachie begin drink even when Reading win match to take celebrate.

But everything finally cast for 2011 when them lose Premier League promotion playoff against Swansea and oga McDermot against Swansea and the coachie find himself inside serious depression wey no amount of alcohol for save am.

Oga McDermott finally carry Reading win relegation to Premier League for 2012

And by the time wey him finally help Reading promote enter Premier League for 2012, all him life dey inside bottle of ogogoro sotay if him never drink one shot before match, him no dey fit focus.

The good news be say oga McDermot don finally break him alcohol addiction and for the last 7 years any single drop of alcohol never enter the man system, not even Star Lite.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version