As e dey Hot

Police dey investigate Granit Xhaka yellow card against Leeds after gambler use am hammer £250k

Published

on

Diswan no be small matter o, as we don dey hear say crime fighters inside UK wey dem dey call the National Crime Agency don begin investigate Granit Xhaka yellow card against Leeds say some magomago and wuruwuru fit dey inside after one gambler use that same yellow card take place bet of 52,000 pounds use am hammer winnings of 250,000 pounds. When we meet aboki to epp us calculate am, we see am say dat cash out na about 127 million naira cash we dey talk about so.

If una remember dat Arsenal match against Leeds wey shele for December, Arsenal dey win 4-1 by 80 minutes of the match so nobody expect say any Arsenal player go put himsef under any kind pressure wey go warrant ref to nak am any kind of mumu card. But na inside the 10 minutes wey remain naim somebody decide to place 52,000 pounds betting say Granit Xhaka must collect yellow card. And like play like play, Xhaka deliver for the 86th minute when the ref, Andre Marriner nak the guy yellow card for time wasting. And just like dat, baba wey bet 52k don hammer 250k on top Xhaka head.

Granit Xhaka dey shalaye after ref nak am yellow card against Leeds

But dis big betting and the big winning no too enter well for bookmakers and na wetin make dem rush report the matter to FA. According to dem, dat money too much for the amount of money wey gamblers dey normally bet on top yellow card for full match, talk less of yellow card for just 10 minutes wey the player dey win 4-1. Na diswan con make us dey wonder weda if to say the bobo ticket cut and him money catch fire weda dis bookmakers for still report am to FA abi dem go just lock up.

The bookies also complain say no be normal betting website the gambler bet the money, instead him use betting exchange wey dey also accept betting outside of dem regular registered users. Finally, dem say dat particular odds of Granit Xhaka to collect yellow card increase well well inside dat last 10 minutes wey make dem dey suspect say e be like one accomplice dey inside dat betting exchange wey dey tamper with the odds. Na all diswan make dem forward the case to FA and after 6 months of investigation, FA don hand am over to dem EFCC for UK there.

But make we talk true, Granit Xhaka and yellow card be like 5 and 6. In fact if Xhaka dey match and him never collect card dat means him probably no dey play well. Especially some card wey no even make sense. The bobo jus like to dey swallow card like fufu. Last season alone the guy chop 10 yellow card and 2 red card for league alone. So therefore, if pesin bet for Xhaka to collect yellow card, e nor go dey too surprising. FA no dey suspect Xhaka of anything for now sha as dem jus dey focus on the gambler.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version