As e dey Hot

Carlo Ancelotti and Karim Benzema don win Uefa Coachie and Player of the Year 2022

Published

on

Real Madrid coachie, oga Carlo Ancelotti don win the Uefa Men’s coachie of the year for 2022. Carlo Ancelotti receive the award for the Uefa Champions League draw wey shele dis evening for Istanbul inside Turkey.

 

Real Madrid striker, Karim Benzema also win the award for the Uefa best player of the year. Benzema wey also win the best goal of the 2021/22 UCL campaign with him beautiful heading against Chelsea for dem quarter final first leg also collect him own award for Istanbul there.

Karim Benzema score 44 goals for Real Madrid to win the award

Carlo Ancelotti become the first coachie in history to win the UCL four times when him carry Real Madrid beat Liverpool for the final to win dis year edition. Ancelotti first 2 UCL trophies na with AC Milan for 2003 and 2007. Him last 2 na with Real Madrid for 2014 and now 2022.

As for Karim Benzema, the 34 years old Frenchman score 44 goals plus 15 assists inside 46 matches for Real Madrid last season. Diswan include the 15 UCL goals wey him score for UCL. Na these achievements make am deserve the Uefa best player award.

Other people wey receive award for the UCL draws na Spain and Barcelona attacker, Alexia Putellas wey win Uefa Women’s footballer of the year and Sarina Wiegman wey win the Uefa women’s coachie of the year.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version