As e dey Go

Mudryk say na only 20% of him abilities him don show for Chelsea so make una calm down

Published

on

Chelsea big money winger, Mykhailo Mudryk don come outside dey tackle people wey dey call am flop for Chelsea say make dem calm down because wetin dem don see so far never even reach 20% of wetin him fit do.

Na for January naim Chelsea count £89 million take hijack Mudryk transfer from Arsenal still nak the 22 years old Ukraine player six and half years contract. But after 6 months and 17 matches later, the boy never score one single goal until season end.

And no be say chances no dey come o. Na diswan don make many people begin wonder whether no be Yahoo-yahoo naim dem use the boy take do Chelsea because to buy player for dat kind money yet him dey play like Principals Cup player e get as e be.

Chelsea splash hooge money take hijack Mykhailo Mudryk from Arsenal

But Mudryk finally score him first goal for Chelsea during dem preseason against Brighton. And na after the sweet goal naim the bobo don come outside now dey warn everybody say the real Mudryk wey Chelsea order don finally land. According to the winger:

“Na dis kind goals I wan to dey cook for Chelsea everyday. I know say as the goal sweet me na so e sweet everybody too but make Chelsea fans no worry. Na just 20% of wetin I fit do naim I don show una but now I dey come with the full package so make una ready to chop wetin I dey cook.”

The boy also hail Chelsea new coachie, oga Mauricio Pochettino say the man really sabi work and right now him dey try bring out the best in the boys. So therefore next season go bloody gan because Chelsea don get new squad.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version