As e dey Go

Messi say him no plan to join PSG but na condition turn GOAT to asun

Published

on

Football legend, Lionel Messi don come outside dey confess about him movement to PSG say the truth be say him no plan to join the French champions o. In fact him no even plan to leave Barcelona wey be the club of him youth. But na condition make am find himself for France.

Na for the end of the 2020/2021 season naim Barcelona announce dem intention to finally let Messi go because at dat point, dem no fit afford am and na only Messi salary alone naim dey run the club down.

As e be then, the only club wey get the kind money to afford the GOAT na PSG so the French club quickly rush go sign the 7-time Ballon d’Or winner put am for hooge salary.  Unfortunately for everybody, dat transfer no go well because the two years wey Messi dey there, the man just be like shadow of himself.

Messi dey do very well for Inter Miami

The Champions League wey PSG dem expect say him go help dem deliver, dem no even near am inside the 2 seasons wey him dey there. To make matters worse even the league wey dem dey dominate before, other people begin follow dem drag am.

Na all dis frustration plus say fans come begin protest in front of Lionel Messi house for Paris say make him carry him kaya leave the club naim make Messi kuku leave the club at the end of last season. And now, the GOAT don come outside dey confess say:

I been no plan to join PSG o. But the thing happen so fast, I dey Barca today, tomorrow I find myself for PSG. I no really understand myself for dat PSG so everything no go well. I try my best o, but I no understand dat PSG at all.

Messi also talk say dis Inter Miami wey him dey really go well pass PSG and say him feel more at home there pass dat PSG wey be like say everybody dey expect miracle from am.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version