As e dey Go

Mane use punch scatter Leroy Sane face after Man City destroy Bayern last night

Published

on

My people no be small katakata burst inside Bayern Munich dressing room last night as we don dey hear say after Manchester City destroy dem last night, African footballer of the year, Sadio Mane enter dressing room go punch him teammate, Leroy Sane for face.

Una remember say City kpokpo Bayern 3-0 for dem UCL quarter final first leg match wey shele for Etihad. The match first start like say na pure game of chess until Manchester City take the lead with one wucked outside R-2 from Rodri to make am 1-0.

Manchester City chook one leg for the semi final after two second half goals from Erling Haaland and Bernardo Silva. And na towards the end of the match naim we see Mane dey hala for Sane head on top pitch with Sane trying to defend himself.

Sadio Mane join Bayern Munich with happiness but right now, na anger the bobo take dey play ball

Many people dey wonder why Mane dey shout for him teammate head, especially since na Sane even hustle to score pass any other Bayern player and na him get attempt pass. Mane sef wey come from bench enter match disappear kpatakpata.

But now we don understand say Sadio Mane no stop with the shouting o, because the bobo continue enter dressing room before him finally provoke kpatakpata use one wucked Israel Adesanya punch take hammer Sane for face, tawai!

According to wetin we hear, e be like say e get wetin Leroy Sane talk wey really pain Mane and when him no fit beat am again, him block the guy inside dressing room use Africaman hand take scatter the guy lips sotay blood full everywhere.

Bayern don confirm say dem go nak Sadio Mane ogbonge fine for dat Oshodi Under Bridge agbero motorpark behaviour wey him exhibit against him fellow teammate so.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version