As e dey Go

Make Chelsea sack Pochettino if him no fit deliver the container- John Obi Mikel

Published

on

Former Chelsea and Super Eagles midfielder, John Obi Mikel don come outside with red eyes dey tell Chelsea owner, Todd Boehly say make him no reason am too much, if Mauricio Pochettino no fit deliver the goods to Stamford Bridge, make him no hesitate to sack am.

Chelsea currently dey 9th on top Premier League table after all the igbakugba wey dem play for the beginning of the season. Diswan na on top the heavy money wey Todd Boehly spend take sign young young players nak dem long term contract. Dis money dey around 1 billion pounds.

But the club don begin bounce back recently with three wins and one draw out of them last five matches. For Premier League, them don win three out of the last three. But if we check those wins na mostly escape dem escape against teams like Luton Town, Fulham, and Crystal Palace. In fact Middlesbrough even beat dem for EFL Cup.

Mauricio Pochettino say na him go break the curse

Na this kind balablu wey dem dey play naim don make John Obi Mikel dey ginger say if Pochettino no fit do wetin dey employ am for, make the club quickly sack am. According to the former Naija skippo:

“I no get anything against Pochettino o. But the truth be say time for excuses don pass. Na wetin make me like Roman Abramovic, once 6 months pass and you never know wetin you dey perform, na sack letter be the next thing wey you go see. As for Pochettino, we wan begin see signs wey go show us say next season will be better. Otherwise make dem remove am sharply.

Chelsea next five Premier League matches na against Liverpool, Wolves, Crystal Palace, Manchester City and Tottenham.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version