As e dey Go

Lauren James don apologize to Michelle Alozie for her bandit behaviour during England vs Nigeria match

Published

on

England women attacker, Lauren James don come outside with sorry for her eyes dey apologize give Nigerian women defender and one of our darling Super Falcons player, Michelle Alozie for the bandit behaviour wey she behave against her assuring dem World Cup match on Monday.

If Una remember during that match wey Super Falcons choke Lauren James for pitch sotay she no fit breathe. So out of frustration naim James, wey be Chelsea midfielder and brother to Reece James use iron stud take stamp for Michelle Alozie back as the Super Falcons defender dey for ground.

Referee first nak James yellow card before VAR call her make she come see evidence for TV. After VAR show the ref evidence finish naim she return change the yellow card to straight red card. England later win the match 4-2 on top penalties after 120 minutes end goalless.

See life

But Lauren James don come outside to apologize to both Michelle Alozie and her teammates say make dem no vex because wetin happen to her na devil work because na her village people suddenly remember her. She say:

To my sister Michelle Alozie, I am very sorry for wetin happen for pitch. I no mean to disrespect you like dat. No matter how bad the thing look for photo sotay Naija people don use am take dey run meme, all na love. And I go always love and respect you.

Reece James sister also apologize to the people of England because of the red card wey nearly end their World Cup dreams because her teammates end up playing more than 50 minutes with 10 men. She say she go learn from diswan and she no go ever try am again.

England women national team sef don kuku accept her apology say she truly dey sorry and no matter wetin happen dem be teammates and now na the time for dem to stand with her through everything.

Lauren James go miss England quarter final match against Colombia. But FIFA still fit increase am to 3 matches after dem review the action. Na dis go be the likely case because na the same thing happen to Super Falcons midfielder, Deborah Balogun.

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version