As e dey Hot

Naija Super Falcons don jabo from 39 to 46 for the latest FIFA ranking

Published

on

FIFA don release the latest world football ranking and when we torchlight the list well well, we see am say the Super Falcons of Nigeria don jabo from 39 wey dem dey before to number 46 now. Dis be like pesin wey danfo carry am back to the last 7 bus stop.

No be only dem position naim the Super Falcons lose for the latest FIFA ranking because dem also lose some points wey FIFA take dey rank the thing. The Falcons lose 69.33 points to fall from 1604 points to 1534.67 points on top the latest FIFA ranking.

Naija Super Falcons try dem best for WAFCON but in the end dem jabo from the competition after losing to Morocco on top penarity

Una remember say the Super Falcons no too try for the last WAFCON wey shele for Morocco, where the 4th place wey dem carry make sure say dem finish outside the Top 3 for only the second time ever. The Falcons lose 3 of the 6 matches wey dem okay for the competition including dem last 2.

After winning the competition 9 times including the last one wey shele for Ghana, dis year own na very poor result for the Falcons and na dat poor result make dem jabo well well for the latest FIFA ranking.

But despite dis jabo wey dem jabo so, the Falcons still dey top for Africa. But South Africa no dey far behind because after jumping from 58 to 54 for the world ranking dem don overtake Cameroon as the Number 2 country for Africa with 1464.36 points. Cameroon dey 3rd and Ghana dey 4th.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version