As e dey Hot

Naija Super Falcons don jabo from WAFCON after losing to Morocco on top penarity

Published

on

Morocco girls wan impress dem 40,000 fans wey make dem start the match like say na half match dem wan play. But after 20 minutes dem don gas wey make Falcons begin pressure dem sotay the girls jus dey miss some kind opportunities.

But na second half naim tins begin happen when VAR nak Naija red card when Ayinde match opponent leg to make Naija one man down. But na Naija still use the one woman down take score the opening goal when Morocco babes do own goal among demsef to make am 1-0 to the Falcons.

Naija Super Falcons don jabo from WAFCON after losing to Morocco on top penarity

But e no tay when Morocco equalise after miscommunication from defence to make am 1-1. Na then the other miracle happen when VAR check again nak Naija anada red card, dis time to Rasheedat Ajibade to make am 2 red card to Super Falcons wey play the rest of the match with 2 players down.

Super Falcons defend with all dem life for the remaining part of the 90 minutes even enter extra time to hold on to penarity. When e reach penarity naim Onumonu go miss for Super Falcons while Morocco score all dem own to win 5-4 on penarity and qualify for dem first ever WAFCON final.

As e be now, Morocco go play the final with South Africa while Naija Super Falcons go play third place with Zambia. Many people go say na VAR kill Naija for the match but at all at all, the babes try and dem qualify for World Cup.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version