As e dey Go

Iraqi footballer don chop 2 years ban for fighting referee wey nak am red card

Published

on

We don dey hear now say one Iraqi footballer don chop ogbonge ban of two years after him try to fight referee wey nak am 2 yellow cards equals to red card during him club Iraqi Premier League match wey dem finally lose 3-2.

According to the tory, na Ibrahim Bayesh wey dey play as midfielder for Al-Quwa Al-Jawiya naim dis thing happen to. Na during their match with Al-Kahraba when scores still dey 2-2 naim referee nak Ibrahim second yellow card to make am red card.

The match strong well well because na Al-Quwa dey top league and dem need to win to remain on top. So when ref nak Ibrahim the red card, the midfielder begin insult the ref, dey shout for ref and after a while e begin approach the ref wan beat am before people separate am.

Iraqi footballer

Na because of that agbero behaviour wey dey suited for Oshodi motorpark not for football pitch naim make Iraq FA nak the guy 2 years ban from football. This means say wherever anything football dey happen, whether na match or training or even monkeypost, dem know wan see Ibrahim there.

Ibrahim no be the only person wey chop ban o, because we also hear say oga Hammadi Ahmed, wey be member of Al-Quwa administrative board also chop 2 years ban because when Ibrahim dey do all that wahala, instead of oga Hammadi as elder to separate Ibrahim, him self go join hand begin push referee dey insult am wan join fight am.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version