As e dey Go

If dem born una well touch one hair for Messi head – Barca fans to PSG Ultras

Published

on

As gbege continue to dey shele for PSG unto Lionel Messi matter wey even some PSG ultras don dey protest against the GOAT, Barcelona and Argentina fans under FCB Albiceleste don come outside dey draw ear give those PSG ultras say, if anything mistakenly go happen to Lionel Messi for Paris, the whole of Europe no go contain dem.

The matter between PSG and Messi finally tie wrapper a few days ago when the club sama 2 weeks suspension without pay on top the head of the former Barcelona forward unto say the bobo travel go Saudi-Arabia without authorization.

But the beef between PSG ultras and the World Cup winner don start long before then as the the ultras go dey boo Messi during match or during training. For many of the fans, players like him and Neymar just dey collect hooge money from the club without anything to show for it.

The booing worst sotay Zlatan Ibrahimovic tell the ultras say dem get luck say no be him dem dey boo like that otherwise him for come there, slap dem, slap dem mama and papa, slap anybody wey come fight for dem, then waka leave the club forever.

And just today some of those fans carry protest enter PSG board meeting while others go Neymar house with banner dey bang the gate dey break bottle even dey burn tyre dey protest day both Neymar and Messi must leave the club by the end of this season.

Na this one don make PSG employ more security people around their training ground and around Neymar and Messi house for Paris just in case some agbero fans decide to actually attack dem or put dem in danger.

Barca fans don nak PSG ultras serious warning

Na all this threaten and intimidation don make those FCB/Argentina fans don come outside with anger and para take dey warn PSG ultras say, if anything happen to dem GOAT, Ukraine vs Russia go look like child’s play. According to them:

”All dis gra-gra wey una dey do make una know where una crase get bus stop o. Because if anything go happen to Messi, even if na one hair una mistakenly comot from the GOAT head, walai talai the kind gbege wey we go run una, if una last 60 seconds, una win. Because e go bloody gan.”

Lionel Messi don make am clear say him dey leave PSG once him play him last match dis season. Although clubs like Al-Hilal inside Saudi dey promise am the grandfather of all contracts ever in football, Barcelona fans dey believe say him go accept pay-cut and return to the club.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version