As e dey Go

Ibrahimovic na pot wey dey call kettle black – Sergio Aguero

Published

on

After Sweden big striker, Zlatan Ibrahimovic come outside dey tackle Argentina World Cup players say them no get respect, former Argentina striker, Sergio Aguero don come outside with flying tackle take dey blast Ibrahimovic say na him be the oga kpatakpata of everything him dey accuse Argentina of doing.

Na some days back naim Ibrahimovic come outside dey praise Messi say e be like na him be the GOAT true-true. But instead of to end am there, the Milan striker decide to go a step further begin tackle Messi Argentina teammates say all of them get nonsense disrespectful behaviour.

Na that talk don make Sergio Aguero wey suppose go World Cup with Argentina if not for heart condition wey make am retire from football come outside with anger begin tackle Ibrahimovic say him na amala pot wey dey call kettle black.

Aguero and Ibrahimovic jam each other for Manchester derby

According to the former Manchester City man:

“Shay na the same Ibrahimovic wey dey fight on top pitch like Primary school children abi another one? Same Ibro wey dey fight him teammates inside dressing room? Ibro wey when Manchester City play him club then, Manchester United, the guy want fight Otamendi and exchange words with Pep Guardiola?

“Bros if you dey talk of disrespectful players, na you be the oga kpatakpata of them. You just dey beef Argentina because them win World Cup wey your own country no even for qualify for. Nna leave wetin happen for World Cup for people wey actually go Qatar, no be you wey dey watch am for TV like Musa and Akpan.”

If una remember, true true Ibrahimovic don fight with him teammate for dressing room both for Serie A and for MLS. Once him and Lukaku nearly throw blow for pitch wey make ref nak them yellow card each before Ibrahimovic collect second yellow wey send am packing.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version