As e dey Hot

‘I no dey waste energy for mumu-mumu things’- Kylian Mbappe to Emiliano Martinez

Published

on

France and PSG super striker, Kylian Mbappe don come outside dey respond to Emiliano Martinez unto all those insults wey the Argentina keeper insult am say him no kuku get time for any mumu thing wey Martinez dey do.

Una remember say the whole gbege start after Martinez save one penarity to help Argentina beat France win the World Cup. After match naim Martinez enter Argentina dressing room say make them observe a minute silence for Mbappe and France.

But the one wey pain people pass na when Argentina dey do them trophy parade and Martinez use Mbappe face take put on top doll baby to show say na him be Mbappe papa. And na this one make France FA lodge official complaint five Argentina FA make them caution their pikin before him enter market square.

Na this one Martinez do wey pain many people pass

And now, Kylian Mbappe don come outside dey clear everybody say all those boju-boju wey Emi Martinez dey do na for him pocket because him no get time for all that nonsense.

According to the World Cup top scorer: as you see me so, I no get time for any oloriburuku something so I no dey even waste my energy on top. If Martinez like make e dey mumu himself, how da wan take be my problem?

While Kylian Mbappe agree say the World Cup final loss pain am well well because na him life goal to win am again, the bobo also yan say him don already move on to the next one and him concern now na to continue dey play ball and continue dey give him best for PSG alongside him teammates like Lionel Messi.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version