As e dey Go

Emiliano Martinez vs Mbappe: France FA don forward complain against Argentina keeper

Published

on

We don dey hear now say France FA don officially file complaint on top Emiliano Martinez matter unto the way the Argentina keeper take dey mock and insult Mbappe since that World Cup final inside Qatar.

Una remember say na France and Argentina play the final wey even though Argentina dey lead 2-0 for half time, by full time Mbappe don equalise 2-2 for France.

Mbappe complete him hat trick inside extra time to take equalise 3-3 but e still no reach to dash France the World Cup as Argentina finally beat them 4-2 on top penarity shootout.

Although Mbappe later win the golden boot award for the tournament, Emiliano Martinez no send am because immediately that final match end naim Martinez crase start. First the keeper enter Argentina dressing room say make them observe a minute silence for Mbappe and France.

Emiliano Martinez first console Mbappe after the match before village people decide to use am

But the one wey pain people pass na when Argentina dey do them trophy parade for them capital and Martinez use Mbappe face take put on top doll baby to show say na him be Mbappe papa. And na this one many people see finish talk say mbanunu, Martinez don dey behave like village people.

As e be now, France FA presido, oga Noel Le Graet don report Martinez behaviour back to Argentina FA. According to the oga, this Martinez behaviour towards Mbappe dey very abnormal and them suppose rush the guy go Yaba left before the thing turn to something else.

The oga talk say Martinez dey behave like Emilokan and say no matter how hard him try, him no fit understand the keeper behaviour because as far as football is concerned, na balablu and bulaba naim Martinez dey do say. Therefore make them caution am before e carry that behaviour enter market square.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version