As e dey Go

Harry Maguire believe say him go play plenty matches for United this season

Published

on

Former Manchester United skippo, Harry Maguire don come outside dey talk say him believe say Manchester United go still give am plenty more opportunities to play football and prove him worth as a part of dem defensive formation.

Diswan dey come after the defender come from bench to score another own goal during England friendly with Scotland on Tuesday wey make many fans begin wonder whether the 80 million pounds defender go ever improve again abi na only calamity him go dey come pitch come dey commit.

Na just before the start of the season naim Manchester United coachie, oga Erik Ten Hag remove the captaincy from Harry Maguire hand carry am nak Bruno Fernandes. Diswan na after many many years wey Maguire don dey play igbakugba take dey compromise United defence with anti-club activities on top pitch.

Harry Maguire score beautiful own goal against England

After him lose the captaincy, many people begin believe say time don reach for am to finally leave the club. In fact West Ham don already agree to sign the former Leicester City defender for 30 million pounds only for Maguire to do about-turn say him no wan go West Ham because him wan remain for Manchester fight for him jersey.

And now, after yet another blunder, Maguire don dey expect oga Ten Hag to give am more opportunities as a Manchester United player. According to the former skippo:

I know say I never play any of the first 4 matches of the season for Manchester United. And I know say I just score one beautiful own goal for my last match. But season just start. We go play league, play UCL, play FA Cup, play Carabao. Nna matches plenty and e sure for me say I go play many matches.

Manchester United currently get plenty injury crisis for defence with big defenders like Rafael Varane, Martinez, Victor Lindelof and Luke Shaw all injured. In fact na Maguire and Johnny Evans finish dem last game against Arsenal. And e possible say one or two of dem go still start the next match against Brighton.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version